During di 2016 elections, New Patriotic Party argue say "we have the men," one slogan which chaw Ghanaians follow take vote di party into power sake of dema claim say more intellectuals den experts dey di party inside.
But people start dey question where di men dey after another road accident for di Madina-Adenta highway top kill one senior high school student on di spot. Di female student die sake of no footbridge dey di road top which make di over speeding vehicle kill am.
According to Selorm Brantie, one of di leaders for Concerned Residents of Adenta, dem count up to 192 deaths for di road top so far.
Di concerns be say despite di chaw ministers, government appointees, presidential staffers den noise wey Madina den Adenta residents make over di footbridge matter, government no take action yet until say violent protests happen.
After di riots, government release joint inter-ministerial committee press statement which indicate say dem go start fix am next week. But dis no impress some Ghanaians who dey argue say e be after di demo happen before dem wan solve di problem.
People enter social media dey express dema disappointment on di poor response to citizen concerns until say dem resort to violence before leaders go react.
Source: bbc.com
Disclaimer: Opinions expressed here are those of the writers and do not reflect those of Peacefmonline.com. Peacefmonline.com accepts no responsibility legal or otherwise for their accuracy of content. Please report any inappropriate content to us, and we will evaluate it as a matter of priority. |
Nana addo should fix the footbridge ,there after he should get ambulance for Ghana ambulance service 100 now then 20 each year. The footbridge should have lcd screen facing drivers using roads that inform drivers like eg seat belt on/ buckle up ,50km/hr, speedkills ,slowdown etc it can be done on N1, N2, N3 .Also on areas with high pedestrain traffic they can install only flashing solar yellow traffic light.